Aluta Chop Chop – A Poem by By Bolutife Oluwadele

Aluta Chop Chop – A Poem by By Bolutife Oluwadele

Aluta Chop Chop

 

Comrade, mai Dokinta of the abroad

Supremo Comradium of Ilya Du Lasgidi

You are wokedly karid

Truly you be àbẹ́tẹ̀ guy

Na bunker dem dey call am o

Da Chiefesis of the bunker

 

Come o, hao you take know dis tin sef

Somtin wey be opendential

Na lie, e get wetin you dey hide

I be ritaya fellow nau

I talk am. For wia nau

For Ilya du Kontago

 

Wetin come ritaya you nau

I nor wan be Pásítọ̀ Ọlọ́gọ̀rọ̀ again

Las las you gree say you be Pásítọ̀

Abegi, nor talk am loud

 

Na wa o, wondament nor go fit pafuka

Leef am laik dat make we yarn somtin

Wetin we wan yarn today

I hia Ben Johnson come Abuja

 

Who be Ben Johnson

You nor know Ben Johnson Olympian again

Dem do Olympics for Abuja

Na ECOMOG dem do for Abuja

 

Make you yarn straight mai fren

Dem do Aluta for Abuja

Hao Ben Johnson take enta

Benjy fere ge (tear race)

Your confusion is confusing me

Dem run for dia laif

 

You are speaking in tongues

There was a protest in Abuja

Then what happened

A race for live video emerged

 

You are confusing me

Government has stomach infrastructure

And civil society has what

Aluta chop chop

 

Gone are the days

Of West African Students Union

That stood against the colonialists

Not for filthy lucre

 

Music don change

Gbedu don bend for kona

Ujesha yarn am o

Hao dem take yarn am

 

Hún ẹ jẹ lẹ́ í wá

Na wetin im wan chop

Na im e dey look for

Nor be Ekiti talk dat wan

Hao e take different

We dey different nau

Two stubborn brodas

We be tiri sef

True true, Ondo follow join.

 

You wan blame am

Who send am message

Make e allow dem waste am

I nor yarn dat wan o

 

Wetin go happen nau

I wan waka fess

Wetin you wan go do

I wan go balance budget

As hao nau

I nor be akatant again

Fópomọ́yọ̀ (diluted) akatant laik you

Somtin we dey blood

 

You go run mai own hinsaid

Hinsaid wia nau

The budget wey you wan do

E nor go balance again o

Haba nor do laik dat fah

Shebi you call me name nau nau

Persin nor fit play with you again

You beta Ben Johnson with ya legs o

 

We no be paddy again

Dat wan nor rish budget side o

Make I go join aluta

Na dat wan go beneficial you

Beht I nor get Ayẹta (bullet repellant) o

Benjy go run am for you.

 

Everything is upside down

Once a noble cause

Has become a veritable avenue

For making easy money

And keep fooling the populace

By their high-sounding rhetoric

That is nothing but hypocrisy

Of the highest order.

 

Now we are saddled with two evils

Gofament belle face front

And aluta chop chop

With masses confused as it can ever be.

 

©TheVillageBoy.

(The figure man who loves alphabets)

Join the discussion

ThemeForest

Instagram

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

About Author

Jollofmash.com.ng

 

Lagos, Nigeria