The Contempt – A poem by Bolutife Oluwadele

The Contempt – A poem by Bolutife Oluwadele

This dialogue poem by Bolutife Oluwadele is coloured in Pidgin and Yoruba language.

 

“Igí sún mọ́ gi, lọ̀bọ fí ńṣakọ 

Igí sún mọ́ gi, lọ̀bọ fí ńṣakọ 

Tí gi bá jìnnà sí ra wọn 

Ọ̀bọ kò ní skill 

Igí sún mọ́ gi, lọ̀bọ fí ńṣakọ”

 

Bobo Lactogen Abasido Olorin

Dokinta troubleshooter of abroad

Which kind yeye greeting be dis wan

Which taim I yarn you say I be Fuji musician

Nor be you just sing nau nau

And then?

No vex Aroole Omo Rapala of Lasgidi

Aswear down

Say wetin hapin again o

Somtin must dey do you?

Nothing dey do me o

Kontinuu you hia

Shey nor be wetin I dey tink sha o

Wetin you bin dey tink o, Masta thinker

 

Well nor be mouth you hia dat wan

Hia wetin o

Say Baale wife get winch

If e come get nko

Na winch kasha go announce dat wan

If dem send you to announce nko

 

Tufiaka, God forbid bad somtin

Henniwey na Lagos landlord wahala o

Dem gee you quit notice

Dem nor fit comot for my own bunker nau

 

Beht you nor be Lagosian nau

Who sai?

Ya papa nor come from Lasgidi

Na hia dem born and lactogen me o

You still nor be Ọmọ onílẹ̀

Forget dat wan

 

Okay, wetin hapin ganan ganan?

Na so laif suppose be

How e take be nau

Nor let me swear for you fah!

 

Wetin I do you?

Wetin you no do me

Say I hola you as you dey sing

I go vex for you fah

 

Okay, yarn me wetin dey vex you

Chai, you sabi pretend wella

I nor dey pretend hennitin o

Okay o, if you yarn so

 

But I am really now confused

That you don’t know the economic situation

If you have only be forthcoming

Do I have to speak from both mouths?

 

Tru to God, e get as e be

Wia ya head go before before

E still dey mai neck fah

I tink you borrow persin before

 

Come to think of it

Can a successful village Headmaster

Succeed as a College Principal

In a completely different setting

 

It will depend on certain factors

What might those be?

That though a part is similar to the whole

But may not exactly be the same

 

Though we keep hope alive

Hopefully, we are not delusional

Hoping against hope

Until our hope is renewed

Or else….

Make yawa no go come gas!

 

Bolutife Oluwadele 

 

©TheVillageBoy.

Join the discussion

ThemeForest

Instagram

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

About Author

Jollofmash.com.ng

 

Lagos, Nigeria